Dataset Viewer
Auto-converted to Parquet Duplicate
text
stringlengths
19
2.51k
di high court for lafia, nasarawa state, don sentence oluwatimileyin ajayi to death by hanging for di death of national youth service corp member salome adaidu.
justice simon aboki wey preside ova di case sentence di suspect on thursday.
di judgment find oluwatemileyin ajayi guilty of killing and dismembering (cutting to piece) di late salome adaidu.
dem bin charge ajayi wit one count of culpable homicide contrary to section 221 of di penal code of northern nigeria wey dey punishable by death.
police bin gbab timileyin ajayi wey say e be gospel singer wit adaidu head on sunday 12 january near one church for orozo.
one video wey bin go viral on social media, show as pipo surround ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head of di lady wey be corps member.
im bin tok say adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year. but salome family deny am.
tori be say ajayi allegedly murder salome wen she bin visit am for im house for papalana axis for new karshi for karu local goment area of nasarawa state.
police bin parade timileyin wit di knife and machetes wey im bin allegedly use commit di crime.
first born of di adaidu family, patience unekwuojo adaidu, tell bbc pidgin afta di judgement for court say "notin fit bring my sister back, but im [timeleyin] death dey sure, i too sure about im death " she add.
she tell bbc pidgin say "god dey in control of evritin
befor di mata go court, she bin make am clear say "timileyin no be her [salome] boyfriend" and add say dem as family no sabi di guy as her boyfriend.
according to patience, late salome bin get beta plans for life and her oga for nicon insurance bin just register her for one online training wey she dey do evri saturday.
di first time wen dem bin call her to do dis professional course, na so my sister call me dey happy. she no dey spend money anyhow, she get beta plans for her life," patience add.
salaome na 24 - year - old wey bin dey do her national youth service corps (nysc), for nicon insurance for abuja, nigeria capital.
she be di fifth pikin and fifth girl for a family of six.
di late salome mama bin tell bbc pidgin say 'salome na my husband since my husband die, i want justice for my daughter
afta police arrest am as di main suspect for di murder of late salome eleojo adaidu, dem drag am go court.
dis na afta di family of adaidu bin call for justice as dem still dey mourn di tragic and sudden death of dia daughter.
di high court of justice for lafia, nasarawa state start di trial of ajayi before dem adjourn di trial to 17 - 20 march, 2025.
dem rush di trial afta di judge wey bin preside tok say dem get to rush am sake of national interest.
ajayi bin plead not guilty to di one count charge of culpable homicide wey dem sama ontop im head.
ajayi bin show face for di high court of justice, lafia, di nasarawa state capital wia dem arraign am on monday 27 january, 2025.
na justice simon aboki bin preside ontop di case for di hearing.
channels report say di prosecuting counsel stanley nwaforagwu, afta di arraignment, tell tori pipo say "dem properly arraign di defendant, timileyin ajayi bifor di high court of justice, lafia on a one - count charge of culpable homicide punishable wit death.
dem take im plea and im bin plead not guilty to di charge and dem set di date for trial.
afta di hearing period na on thursday 27 june wey court sentence am to death by hanging.
as anoda election year dey come closer, nigeria election body di independent national electoral commission (inec) say dem don receive letters from ova 100 associations wey wan register as political parties.
some of di names you go begin hear if inec register dem na advanced democratic alliance, (ada), pink political party, zuma reform and obidient peoples party (opp).
professor mahmood yakubu, wey be di chairman of di commission tok on wednesday say dem dey process di requests according to relevant laws, regulations and guidelines of di commission.
as of monday, 23rd june 2025, di commission don receive letters of intent from 110 associations wey wish to register as political parties. we dey take our time to process di requests in line wit di procedure outlined in law as well as our regulations and guidelines. we don acknowledge all requests wey we receive.
so far, we don acknowledge all applications we don receive, except for six, wey dem submit recently. we go acknowledge dem before di end of di week," im tok.
professor yakubu tell nigerians, especially di pipo wey get interest to register political parties, to consult di comission regulations and guidelines for political parties 2022.
inec also release di full list of all di 110 associations, dia proposed names, abbreviations, dia address and di names of dia chairmen and secretaries.
wit evri new political year, new parties dey showface and some of dem no dey stand di test of time.
rivers state police don condemn di attack on di sole administrator of ahoada - east local goment area, goodluck iheanachor and invite im chief of staff to come answer kwesion on di matter.
police claim say hector ekakita, wey be di chief security officer and di chief of staff to di sole administrator allegedly storm di council secretariat wit 30 jaguda pipo, wey attack oga iheanacho.
di attack happun on friday 20 june for di council secretariat according to police.
during di attack, di jaguda pipo beat di sole administrator, tiff im mobile phones, force am to sign im letter of resignation, den go away vital documents, including official and personal documents from im office, police tok.
dis incident dey happun few months afta rivers state sole adminstrator vice admiral ibot - ete ibas bin appoint 23 sole administrator few months ago for all di local goment area ,to torchlight dia activities afta im appointment.
dia work na to perform di functions wey normally di elected officials go do, dia work include managing di council administration, finances, and personnel, as well as representing di lga in various matters.
police say iheanacho dey hospital wia im dey currently collect medical treatment sake of di injuries wey e get during di violent attack. im dey stable condition.
meanwhile di commissioner of police, olugbenga adepoju, visit di scene of attack wit heads of oda sister security agency for di state and vow to take action.
for di viral video, honourable iheanacho wear grey native sitdom for ground, surrounded by di jagudu pipo.
di 1:25s clip wey bbc no fit verify show as di jaguda pipo flog di sole administrator of ahoada - east local goment area and shout on am to sign di document wey dem give am.
di jaguda pipo later tie im hands and call one guy wey im name na sir charles to confam di signature.
afta dem tie di sole administrator hand anoda man wey wear black jeans and green t - shirt enta di room.
one of di boy shout ''who be dis one'' bifor dem tem am to lie down and begin to flog am too.
di chief security officer and di chief of staff to di sole administrator of ahoada - east local goment area don deny say im carry jaguda pipo to visit and attack dia oga, goodluck iheanacho.
for one voice note hector ekakita deny di accuse and explain wetin happun.
according to oga ekakita, e say ''na di youth of di local goment wey visit am to try to find out why im no gree take care of di council, wey include sanitation, paying off of security and political appointees.
as cso i only see pipo wey enta im office and come out, so anybody wey dey mention my name, i bin no dey di scene of di crime and i no mobilize anybody''.
if di youths come to ask am wetin im bin dey do wit di simplified pipo to di extent of carrying cv of one fabian braide wey im bin lodge for meb hotel for 2 - 3 days to employ am to di council''.
di youth approach am to ask am wetin dey happun and me i no know wetin happun dia between him and di youth''.
only for me to hear say im don sign for im resignation, i no get hand inside di mata na him know di pipo im dey call jaguda pipo''.
anybody don hear of killing, shooting or kidnapping since i assume office'' di cso ask?
so na him know wetin im tell di youth wey dem begin exchange words''.
anything wey happun dia i no dey dia, so make im tell police di truth''.
di pipo wey visit am na youths from di lga no be thugs
na march 18, 2025, president bola tinubu declare state of emergency for rivers state and suspend di governor, im deputy and all lawmakers for di state parliament for six months.
for one nationwide broadcast on tuesday evening tinubu say im receive "disturbing security reports wia im detail incidents of vandalization of pipelines by some militants without di govnor taking any action to curtail them".
im add say im no allow di "grave situation" to kotinu.
but lawyers and opposition politicians dey kwesion di legality of di president decision.
tinubu bin make di announcement afta one of di kontri highest producing crude oil pipelines, di trans - niger pipeline, bin suffer significant damage sake of blast.
in di past criminal gang or militant don carry out attack on pipelines wey, halt production and exports.
at current prices, the oil flowing through the affected pipeline fetches around $14m (11m) a day, according to the online publication africa report.
but against the backdrop of the blast, there has been a political rift in rivers state that has reached boiling point.
govnor siminalayi fubara na member of di people democratic party wey dey face serious wahala.
pdp na di main opposition party to di president's all progressives congress.
tinubu say politicians no bin fit work togeda effectively sake of di wahala. im allege say fubara allies bin threaten "fire and brimstone" against di govnor enemies and dem no "disown" dis comments.
rivers state lawmakers bin threaten to impeach di govnor and im deputy.
tinubu say dis political crisis don leave rivers state im "standstill" im add say dis im move dey based on di need to restore peace and order for di state.
fubara react to di state of emergency, im say na "political disagreements, but good governance dey kotinu".
rivers state dey safe, secure and peaceful under our watch," im tok.
di state of emergency allow di goment to run di state in di interim and dem go send security forces if need dey.
i lose two sons and oda relatives because of dis wicked act by mob, my husband leave me with 13 children".
na so faji sani, wey lose her pikin, husband and oda relatives for di attack on travellers for plateau state tok.
mrs sani dey ask di govment for justice and compensation.
di recent killing wey happun for mangu local government area of plateau state, north central nigeria wia mob kill some travellers, don cause serious reactions in di kontri.
di victims bin dey travel from zaria for kaduna state on saturday to go attend wedding for qua'an pan local government area of plateau state, wen mob intercept dem for mangun district.
some of di travellers die for di scene, while odas sustain different kaind injury, and dem dey hospital now for treatment.
authorities for nigeria say about 13 pipo die afta some pipo ambush one bus wey belong to ahmadu bello university for zaria.
kaduna state govnor, senator uba sani, don condemn di killing as e describe di attack as "wicked and senseless" and e insist say dis kain tin no suppose go free witout punishment.
no reason dey to attack any nigerian for any part of di country" di govnor tell bbc hausa.
dis kain wickedness suppose make everibodi vex, and dem must find dos wey do am and deal with dem well.
govnor sani tell im counterpart for plateau state, govnor caleb mutfwang, make e act, join hand wit security pipo so justice go happun.
i go follow di investigation myself. we must show say impunity no go dey allowed again" im add.
president bola tinubu wey also condemn di killing say di attack dey "unacceptable and barbaric.
e don also order all security agencies make dem catch di pipo wey do am and carry dem go face justice.
freedom to waka anywia for nigeria na right wey nobodi fit collect. we no go allow anybody or any group use violence or fear try stop citizens from moving freely.
dis recent attack on travellers for plateau state don bring up di tok about di safety of travellers for nigerian roads, as e no be di first time e dey hapun.
dis attack dey come months after anoda attack on travellers for edo state, for southern nigeria, wia mob kill some travellers - hunters - wey bin dey travel to kano for northern nigeria through uromi.
for 2018, one nigerian army officer wey be former chief of administration, major general mohammed idris alkali (rtd), go missing wen e dey travel from abuja go bauchi. later dem find im dead bodi for plateau state, according to reports.
wetin dey worrying now be say apart from bandits wey dey kidnap or kill pipo for road, if person dey travel for road, e fit still fall victim of mob lynching for nigerian highways.
some pipo don chook eye say, di extra - judicial killings of travellers for nigerian roads fit don come up as a result of di rise of insecurity and persistent attacks on communities by armed men, weda dem be herdsmen or bandits.
but security expert, auwal bala, wey be senior private security consultant for borno state, believe say di main reason why pipo dey lynch travellers for nigerian roads na sake of say, dos wey dey do am no dey face punishment.
e tell bbc pidgin say, some of di mobs wey dey do dis kind tin get political, ethnic or religious reasons behind am.
some dey do am sake of politics, religion, some becos of tribe, but anyhow e be, nobody get right to kill person just like dat even if di person commit offence" oga bala tok.
e also tok say even wit all di insecurity kasala wey dey nigeria now, pipo no suppose take law for dia hand.
you no fit just dey kill travellers sake of your area dey face security wahala, you suppose consult or confirm who dem be.
End of preview. Expand in Data Studio

No dataset card yet

Downloads last month
34