audio
audio | text
string |
|---|---|
How you dey now?
|
|
Hope sey you sleep well?
|
|
Ah my sister, I sleep well o!
|
|
Una get light for una area last night?
|
|
We no get o.
|
|
Ah wetin happen now?
|
|
Toh na NEPA o!
|
|
Aha dese people, I hear sey de dey share di light.
|
|
My sister, di tin tire me o!
|
|
De just dey share am, but de go dey bring big bill.
|
|
In fact, dat bill na anoder tin again.
|
|
Na so my sister.
|
|
How much de dey, how much, how much de dey give una for una bill?
|
|
Ah my sister, na seven thousand o!
|
|
Seven thousand for di light wey we no dey see?
|
|
Ah dese people, eh de no go kill person o!
|
|
Toh how you dey manage now?
|
|
My sister, I dey manage am.
|
|
Eyah God go help us.
|
|
E get one soup like dat wey Mama Maro bin teach me.
|
|
Di soup make sense.
|
|
I hear sey na Ibo soup.
|
|
I know sey you go like am.
|
|
Teach me too now.
|
|
Shebi you know banga soup?
|
|
I know banga soup.
|
|
Ehn na di soup.
|
|
So it's like I go come, me, and you go, go do am.
|
|
Di soup go make sense.
|
|
You go like am well, well.
|
|
Abi meh I give you.
|
|
You know how de take dey cook di soup?
|
|
Ah my sister, my junior sister bin teach me how de take dey cook am o.
|
|
You fit tell me small?
|
|
Eh e say you go parboil di banga.
|
|
After you parboil am, you go come pound am.
|
|
When you pound am, you filter am.
|
|
Den you put eh your ingredient inside.
|
|
Na so my teacher, my sister take teach me.
|
|
Na starch, or na eba?
|
|
I dey like starch well, well.
|
|
Starch hm, na starch I dey like.
|
|
Ehn na dat one I dey like pass.
|
|
Dis morning, wetin you eat before you come here?
|
|
Ah my sister o, mtschew toh I eat eba o!
|
|
Hehe why you no drink tea?
|
|
Hm my sister, I no dey too like tea.
|
|
Na swallow I like pass.
|
|
Okay wetin you eat before you sleep for di night?
|
|
Ah well my sister, I just take small rice.
|
|
Hope sey di rice sweet sha?
|
|
So, any, any news?
|
|
You hear any news for area?
|
|
Concerning dis our NEPA issue, I bin hear sey de say de wan come cut light tomorrow.
|
|
My sister, na so I hear am o.
|
|
De say de wan come cut light tomorrow.
|
|
Make dese people no come o because we don tire for dem!
|
|
Me masef, I no even get money to pay.
|
|
Hey dis one na wahala o.
|
|
Dis one wey everywhere dry, no money.
|
|
I just pray make dem no come.
|
|
Make dem no come!
|
|
Because if de come, dat means na all di whole area dem go cut deir light o.
|
|
Because people no, no money.
|
|
And we no dey see light.
|
|
Hm meh NEPA no try us o!
|
|
I no sure sey dem go even come sef.
|
|
Madam, I wan make me, and you go market next market day.
|
|
Gwagwalada Market, abi Kwali?
|
|
Which day be Kwali market?
|
|
Ah we go try go o.
|
|
Wetin you wan go buy now?
|
|
I wan go buy shop tins.
|
|
Mtschew e get some kind tins wey I need for my shop.
|
|
I wan make me, and you go.
|
|
Because you no go see provision dere o.
|
|
Eh na true o.
|
|
I fit see shampoo, and attach ba?
|
|
My sister, you no go see o!
|
|
Na food product dey dere.
|
|
If we go toh, we would just buy tins wey we go take cook some kind soup.
|
|
When I wan go, I go come call you.
|
|
I go house dey wait you.
|
|
Me too, mey I go hustle for money so dat if we go, I go buy enough tins.
|
|
I go call you.
|
|
Dat your number wey give me last, eh last week, shebi na di number you still dey use?
|
|
Na im I still dey use.
|
|
X sometime, I dey try di number.
|
|
Di number no dey go o.
|
|
Ah dis network again!
|
|
I go flash you with my number before we leave here.
|
|
I dey expect am.
|
|
Which church you dey go now?
|
|
My sister, na CAC.
|
|
You don comot for Pathfinders?
|
|
Hm mtschew I don comot jor.
|
|
Dey go CAC now.
|
|
Eyah how di church now?
|
|
Ah we thank God.
|
|
Hope sey de dey preach well?
|
Subsets and Splits
No community queries yet
The top public SQL queries from the community will appear here once available.