audio audio | text string |
|---|---|
How you dey now? | |
Hope sey you sleep well? | |
Ah my sister, I sleep well o! | |
Una get light for una area last night? | |
We no get o. | |
Ah wetin happen now? | |
Toh na NEPA o! | |
Aha dese people, I hear sey de dey share di light. | |
My sister, di tin tire me o! | |
De just dey share am, but de go dey bring big bill. | |
In fact, dat bill na anoder tin again. | |
Na so my sister. | |
How much de dey, how much, how much de dey give una for una bill? | |
Ah my sister, na seven thousand o! | |
Seven thousand for di light wey we no dey see? | |
Ah dese people, eh de no go kill person o! | |
Toh how you dey manage now? | |
My sister, I dey manage am. | |
Eyah God go help us. | |
E get one soup like dat wey Mama Maro bin teach me. | |
Di soup make sense. | |
I hear sey na Ibo soup. | |
I know sey you go like am. | |
Teach me too now. | |
Shebi you know banga soup? | |
I know banga soup. | |
Ehn na di soup. | |
So it's like I go come, me, and you go, go do am. | |
Di soup go make sense. | |
You go like am well, well. | |
Abi meh I give you. | |
You know how de take dey cook di soup? | |
Ah my sister, my junior sister bin teach me how de take dey cook am o. | |
You fit tell me small? | |
Eh e say you go parboil di banga. | |
After you parboil am, you go come pound am. | |
When you pound am, you filter am. | |
Den you put eh your ingredient inside. | |
Na so my teacher, my sister take teach me. | |
Na starch, or na eba? | |
I dey like starch well, well. | |
Starch hm, na starch I dey like. | |
Ehn na dat one I dey like pass. | |
Dis morning, wetin you eat before you come here? | |
Ah my sister o, mtschew toh I eat eba o! | |
Hehe why you no drink tea? | |
Hm my sister, I no dey too like tea. | |
Na swallow I like pass. | |
Okay wetin you eat before you sleep for di night? | |
Ah well my sister, I just take small rice. | |
Hope sey di rice sweet sha? | |
So, any, any news? | |
You hear any news for area? | |
Concerning dis our NEPA issue, I bin hear sey de say de wan come cut light tomorrow. | |
My sister, na so I hear am o. | |
De say de wan come cut light tomorrow. | |
Make dese people no come o because we don tire for dem! | |
Me masef, I no even get money to pay. | |
Hey dis one na wahala o. | |
Dis one wey everywhere dry, no money. | |
I just pray make dem no come. | |
Make dem no come! | |
Because if de come, dat means na all di whole area dem go cut deir light o. | |
Because people no, no money. | |
And we no dey see light. | |
Hm meh NEPA no try us o! | |
I no sure sey dem go even come sef. | |
Madam, I wan make me, and you go market next market day. | |
Gwagwalada Market, abi Kwali? | |
Which day be Kwali market? | |
Ah we go try go o. | |
Wetin you wan go buy now? | |
I wan go buy shop tins. | |
Mtschew e get some kind tins wey I need for my shop. | |
I wan make me, and you go. | |
Because you no go see provision dere o. | |
Eh na true o. | |
I fit see shampoo, and attach ba? | |
My sister, you no go see o! | |
Na food product dey dere. | |
If we go toh, we would just buy tins wey we go take cook some kind soup. | |
When I wan go, I go come call you. | |
I go house dey wait you. | |
Me too, mey I go hustle for money so dat if we go, I go buy enough tins. | |
I go call you. | |
Dat your number wey give me last, eh last week, shebi na di number you still dey use? | |
Na im I still dey use. | |
X sometime, I dey try di number. | |
Di number no dey go o. | |
Ah dis network again! | |
I go flash you with my number before we leave here. | |
I dey expect am. | |
Which church you dey go now? | |
My sister, na CAC. | |
You don comot for Pathfinders? | |
Hm mtschew I don comot jor. | |
Dey go CAC now. | |
Eyah how di church now? | |
Ah we thank God. | |
Hope sey de dey preach well? |
Subsets and Splits
No community queries yet
The top public SQL queries from the community will appear here once available.