text
stringlengths
21
14k
Another thing we de for inside dis tori Video, George Floyd: Thousands of pipo dey continue to protest against di death of George Floyd31st May 2020 George Floyd: President Trump threaten say military go shoot pipo wey dey steal for Minneapolis protest29th May 2020 Blackout Tuesday: See wetin di music industry dey plan...
"Di airway and lungs no suppose dey exposed to aerosol, talk less of disinfectant.
But Attorney General Abraham Keetshabe said di judges make mistake.
After di Middle East, na for Africa wey American military get di biggest number of special soldiers.
South African DJ Black Coffee chop nomination for Favourite Global Music Star.
Another thing we de for inside dis tori Serena Williams: Di ‘never give up spirit’ of di ogbonge tennis player24th January 2020 Lassa Fever: How imams dey use mosques educate pipo about di disease for Kano23rd January 2020 Davos 2020: 10 important facts you suppose sabi about World Economic Forum24th January 2020 Lassa...
Hajiya Hadiza add say parents need to train dia children with di right values.
According to AFP tori people, two other men also get injuries for di gebge wey happen, one of dem claim say na police beat am for Ntarikon neighbourhood where im bin wan go meet opposition leader, John Fru Ndi.
He explain say dem dey work over 8 hours but no dey get overtime, dem no have annual leave, sometimes saf dem dey work plus dema bare hands sake of dem no get personal protective clothing den stuff.
Na for April di tori break afta Monica Osagie release audio about how di professor and am bin dey negotiate how dem go increase her marks for im course with sex.
Dis na how life change for Comfort sotey di man wey she love wey don promise to marry her run leave her after im hear di heartbreaking informate about her health.
Di former national chairman of Nigeria ruling APC na native of Edo State.
Dem beat Atletico 4-0 for home, come lose 2-0 away.
Dat result mean say dem don comot for di competition.
Barrister Benjamin Suh Fuh tell case court don register de appeal but "tell give we clients conditions for appeal, make deh deposit FCFA 5million before deh record de proceedings".
Liverpool vs Barcelona: Anfield don comot 'G.O.A.T' for Messi hand 8 May 2019 Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Dis go be di first Champions League final without Messi or Juventus' Cristiano Ronaldo since 2013 Liverpool oga Jurgen Klopp don tok say im dey "overhappy" as im see players dey cry...
Di scheme wey di company say dem do for pipo to "provide help" and "get help", and wey di Central Bank of Nigeria bin warm pipo against, announce on 22 June say dia new system wey dem bin dey work on afta di last shut down, don ready for global launch.
Skip YouTube post, 2 Wetin we call dis Video, Warning: Third party content may contain adverts End of YouTube post, 2 And like say im plan am, 'Something Different' na di name of di first song wey Adekunle Gold drop from di album.
Na because e be like say Nollywood movie superstar, Funke Akindele go show inside di film.
Zuma supporters believe dis case na witch hunt because di former presido wan reform di economy wey go help millions of di majority black pipo comot for poverty.
Maurice Kamto, Cameroon Renaissance Movement, MRC opposition party leader bin tok say if goment set election date weh deh no find solution for Anglophone crisis e go start campaign for chase President Biya for pawa.
For world wey dey warmer, we fit expect make more moisture dey atmosphere and we fit expect say rainfall events go pass normal.
Posted at 17:01 4 October 202017:01 4 October 2020 SARS kill boy inside Ughelli?
Kaduna killings: President Buhari say violence no get winners, but losers 16 March 2019 Wia dis foto come from, STEFAN HEUNIS Wetin we call dis foto, Kaduna State dey also suffer from herdsmen attacks.
Out door learning: some school pikin dem go learn for out door area instead of inside class 5.
But no be only politicians for obodo oyibo dis ban go affect.
But dem never talk wetin di punishment go be for anybody wey disobey di law.
Burundi law no gree make one man get more than one wife or make people just dey live together and dem no marry.
For 2010, di company sign 20 year contract wit Nigeria to create tear rubber natural gas refinery but wen President Buhari enta goment for 2015, im match brake for di deal.
Inside statement wey her director of tok-tok Suleiman Haruna release, Buhari wey don dey follow how di case dey waka wan clear pipo say she no know any of di pipo wey involve inside di wuru-wuru mata.
(@ayodejirotinwa) May 26, 2018 End of Twitter post, 6 Another thing we de for inside dis tori Falz: Nigerian musician go show for Hollywood TV series15th March 2018 Corruption Perception Index: EFCC no suppose ignore 2017 report - Transparency International22nd February 2018 J. Cole for Lagos: Nigerians dey vex for Ame...
PHE don tok say dem go find all di pipo wey near dis pesin for im waka wey include passengers for im flight to UK to give dem informate and health advice.
Boko Haram attack on UN helicopter - See everytin we know Food prices go continue to increase inside Nigeria in coming months?
"Goment e readiness for cooperate fit helep Cameroon for komot for difficult taims, and we bi ready wit UN for support.
Wetin we call dis foto, "Aagbe Wo" demo against growing level of insecurity for Ghana Another thing we de for inside dis tori US whack Ghana plus visa sanctions sake of authorities no want receive Ghanaian deportees1st February 2019 Ghana opposition boycott Ayawaso West Wuogon by-elections after shooting incidence inju...
A friend told me earlier “(it appears)Tanzanians take their public holidays very seriously!” Couldn’t agree with him more!
Uefa Champions League: Real Madrid, Liverpool fit qualify today for knockout stage 21 November 2017 Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Real Madrid dey second for Group H with seven points.
Wetin we call dis foto, Na Poll Officers wey be corpers go announce di result for dia polling unit Another thing we de for inside dis tori Osun election: Meet di candidates wey wan become Govnor20th September 2018 ''We dey say sorry unto Adeleke family bank account freeze tori sake of say na fake news'' - Dele Momodu N...
That's how our govt gave us vision 2020 with no date now see what we are facing.— Eyen Akwa Ibom (@idyudofia10) September 14, 2020 End of Twitter post, 3 Skip Twitter post, 4 I believe Pastor Chris Oyakhilome Prediction on Rapture Happening soon.
ria Independence Day: 2baba say everybody get work to do to make Nigeria beta Dem no support media player for your device Nigeria Independence Day: 2baba say everybody get work to do to make Nigeria beta 2 October 2017 New Informate 3 October 2017 Popular musician Tuface don hail Nigeria on top her 57 years independenc...
— BRAVIN (@ItsBravin) September 15, 2019 End of Twitter post, 3 Others bin remind Nigerians say Beyonce to use any artiste for East Africa as nah di Landscape of Kenya rift valley bin inspaya her Lion King Video Skip Twitter post, 4 When Beyonce decided to release an album with an East African theme and unfairly failed...
Another thing we de for inside dis tori 1:23 Video, May 29: Nigeria economy good for Buhari goment?, Duration 1,2323rd May 2019 1:44 Video, May 29 countdown: How 8th National Assembly don perform?, Duration 1,4425th May 2019 May 29 inauguration: Six Nigerian ministers wey 'vex' pipo for Buhari first term23rd May 2019 1...
On top dis one, person fit get diarrhoea, lymph node wey don swell, sore throat, and wound for mouth.
Harry and Megan don match break as senior royal
Sultan wey win Big Brother Africa before share two picture for Wednesday: one show Mr Magufuli head ontop Sultan likeness - complete with braces, arms dey folded and di sleeves dey rolled up; di other one get di comedian face ontop Mr Magufuli's body - and im seat ontop di presidential chair wey get national seal.
Nigeria Super Eagles don dey ready to face Czech Republic World Cup squad for dem final friendly match wey go happen for Austria on Wednesday afternoon.
Producers: Dan Ikpoyi, Usifo Omozokpea and Dooshima Abu De one we dem don look 2:22 Video, Jane Richards na makeup artist wey fit change her face to anybody face, Duration 2,2225th September 2020 3:05 Video, Waste to Fuel: Meet di young innovators wey wan solve Nigeria fuel palava, Duration 3,052nd October 2020 3:01 Vi...
Gov. Lalong don win Plateau governorship election
Another thing we de for inside dis tori Nigeria v Liberia: George Weah dey use di presidency do play-play?12th September 2018 Liberia: George Weah don become new president22nd January 2018 Liberia: President George Weah don give im kontri highest award to Arsène Wenger21st August 2018 Top Tori FG ban FSARS patrol wit i...
International flight resumption: Nigeria announce 29 August as date for airports to commence foreign travels
Skip Twitter post, 9 Simi’s vocal performance yesterday was very spectacular.
"Wetin I go talk be say make we begin di impeachment of Mr. President, based on dis tin wey im do."
Wia dis foto come from, AFP Wetin we call dis foto, El-Zakzaky don dey hand of Nigeria security agency DSS since 2015 without bail or release IMN accuse goment say dem no dey treat dia leader well, say even El-Zakzaky high blood pressure melecine, goment neva give am for di past four months.
Justice Rilwan Aikawa, order di army and di Chief of Army Staff to suspend di operation till court decide on di mata.
E say di police bin get small kwanta wit di 'terrorist' group wey make one of dia officer wunjure.Police tok-tok oga for Sokoto, Muhammed Sadiq say, di police no allow any kain procession as dem put plenti police officers for street to maintain law and order.
Dis postponement go allow leagues for Europe wey dem suspend to finish.
"My family dey danger wia dem dey stay because I no know who dey enter or who dey comot di place.
Skip Twitter post, 2 This in no way equates or translates to me supporting or approving Gay Rights.
Wetin to sabi about dis 'Jesus' wey enta Africa Some days ago, tori comot say Kenya goment don deport 'Jesus' because im dey collect money for miracles.
"I find am interesting and also di audience too, di fact say we dey work wit older generation musician and dey able to actually attract younger audience."
Some days last week, rumour bin spread for everi wia including social media say President Buhari wan marry im minister Sadiya Umar Faruq last Friday, but one aide to Aisha Buhari tell BBC Pidgin say no be true.
Wetin we call dis foto, Pipo for Southern Borno no fit return to dia village dem as Boko Haram don take over dia land and house Yusuf Amos say dia village dey Gworza near Sambisa forest.
Information Ministry say "between June den August 2018, BB, who dey act on behalf of Dr. Mac-Palm, contact some military personnel who dey power den try run dem so sey dem go plan den execute de take over."
Wenger collect di advice, sign Weah and di tin do wonders for di Liberian striker wey im career cari am go clubs like Paris Saint-Germain, AC Milan and Chelsea.
Sagamu: Remo kingdom dey boil sake of protest against Nigeria police for death of Tiyamiyu Kazeem
Di current Matibabu machine fit check and find 80% of malaria cases, e still far from 99% wey be di level international practice accept, na sometin Brian dey aware of.
Wike - PDP Convention: No single pesin fit influence di outcome - Wike Karina Igonikon , Port Harcourt 6 October 2018 Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook Nyesom Ezenwo Wike, di govnor of Rivers state for south-south Nigeria, don tok say no single pesin fit influence wetin go happun for Port H...
For 2017, French court rule say make dem pay di Duke and Duchess of Cambridge £92,000 (100,000 euros) in damages afta French magazine, Closer print topless pictures of di duchess for 2012.
As at today 2 March, 2020 de Ghana Cedi dey exchange 5.32 to one US dollar.
Di IG bin also send five Armoured Personnel Carriers and three police mobile force unit join.
As pipo dey come our compound to console us-she go just dey tell dem about her wedding and how she dey prepare for di day" " All of us neva fit tell her becos we no know if she fit survive am" im explain.
Tins you suppose know about di 2019 Fifa Women World Cup Super Falcons waya-waya Niger Republic 15-0 Even though di Falcons step up dia game for di second half of di match players like Asisat Oshoala, Desire Oparanozie and Francisca Ordega no fit do anytin to stop di Norwegians as dem cruise to victory.
Di soldiers suffer causalities as di attack happun.
E say im buy di condoms for different dates between January and October 2014 for different parts of di kontri.
All of dem promise say dem go support, to help make all di money wey bad-bad people don thief comot from Nigeria, return back to di country quick-quick.
Ready to win, no matter what Any change for your health wey you want make e dey permanent go take plenty time.
Zamfara attack: Killings, kidnappings dey shake Shinkafi
Pesin fit become addict to different kain tins and di common ones na drug, alcohol, gambling, work, internet, sex, shopping and tobacco or cigar.
Ghana IGP suspend police commander wey force 14-year-old boy chop 36 lashes
⠀ Signed ⠀ Asue Ighodalo ⠀ #wehavelostagem #alegendhasgone ⠀ ⠀ A post shared by Elizabeth R Events (@elizabeth_r_events) on Jun 14, 2020 at 10:26am PDT End of Instagram post, 2 See some tins wey you fit no know about her Wen she be 18-year-old undergraduate of University of Lagos, Ibidunni nee Ajayi, win Miss Lux beaut...
Doris Onyeneke say di major thing wey dey cause dis problem na money mata as pressure don too much for men and some women wey be breadwinners for dia homes.
Instagram don ban 'cosmetic surgery' filters
Di country representative say dem choose Borno because of di living conditions of di IDPS.
Pilot sleep, fly plane pass wia e suppose land Breeze blow aeroplane land upside down Di Piper Malibu N264DB bin dey come from France go Cardiff, wia di 28-year-old Argentine striker go see im teammates for im former club Nantes afta Cardiff announce im £15m transfer Oga Ibbotson, 59, wey come from Crowle, North Lincol...
José Arias escape wen im dey go work- "I just run for one hour I no look back."
Dollar to naira: Why you no need to rush buy dollars Ogechi Obidiebube , Lagos 13 March 2020 Wia dis foto come from, Getty Images Foreign exchange black market for Nigeria dey currently experience increase for dollar to naira.
King Salman son don already dey gain power for economic, diplomatic and domestic policy matter.
JOHESU, wey be join-bodi of health workers except doctors, don dey on strike for almost one month now.
Wia dis foto come from, David Ramos/Getty Images Wetin we call dis foto, Climate change dey also cause drought.
US drone: Trump say Iran make 'very big mistake'
Although di kontri law allow court to give death sentences, dem never kill anybodi since 1994.
7.Chop beta food so dat you and your family no go sick dey go hospital evri time.
Wia dis foto come from, Catherine Ivill Wetin we call dis foto, Odion Ighalo na frontman wey dey play for Changchun Yatai F.C for China.
As dem tok'am, e take hours before de refugee agency reach for Abanda as de road no good, dey even climb mountain.
Skip Twitter post, 4 I just received my COVID-19 confirmation test result.
Rivers Govnorship Election: Sojas and jaguda pipo cause katakata on voting day
Another thing we de for inside dis tori Aisha Buhari: Four times di Nigeria Presido wife yarn tins wey shake table10th December 2018 Fake 'Aisha Buhari': Nigeria first lady don draw body comot Amina Mohammed case6th December 2018 Nigeria secret service don arrest 'fake first lady'4th December 2018 Top Tori SARS, STS, I...
"Dem dey keep animals inside kpoto kpoto and di ropes wey dem dey use too tight."
But de number for pipo weh de arrest nova dey official, as some pipo say 10, and odas "several."
Xenophobia: Goment go epp Nigerians wey dey return from South Africa with 'shikini' moni